E dey good to tell people about bitcoin and when dem want to invest you go tell dem di risk. And ask dem which of the plans dem dey interesting. Na di long term plan or di short term plan because many people think say bitcoin na like get quick rich scheme so some of dem go like to sell within weekly or monthly so you have to go deeply to explain many things to dem so that dem no go misunderstand di investment thing.
One mistake dey do in the investment process, dem go blame you for not guiding dem properly. And don't rush them to invest and if you know say dem go chop di money, you go fit buy keep in your wallet and wen di person Sabi well well, you go fit send give am. And di advice wallet na non custodial wallets.