Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bitcoin will still make our dreams possible
by
Jubilee58
on 07/09/2025, 11:23:08 UTC
https://i.ibb.co/hhYC2vv/IMG-20250725-WA0007.jpg
I love to read about cryptocurrency now most of my social media feed is about Cryptocurrency, I was reading this post and I got the image from the post too yesterday https://www.instagram.com/p/DMfcPeHvLcj/?igsh=cjFieDgyNXhzM2po and according to the post they compared a ten years ago investment across super giants Google, Apple, Microsoft, Tesla, Nvidia and bitcoin’s return on investment after 10 years was $4.23 million only Nvidia tried coming close with $3.5million.

I have also been reading about dormant wallet making transactions after a long time and making ridiculous profits, the early bitcoin adopters are having profit overload but we are not late.

2035 is ten years from today and we pray make God give us long life, to Harvest big from bitcoin in ten years even with a tight capital na now we go need start.

If you fit
1. Dey discipline when spending
2. Find works wey you fit earn in bitcoin or convert to bitcoin
3. Learn to hold and protect the bitcoin make scammers no collect your hard work from your hands

As this steps Dey simple so, na so is easy to start you ten years bitcoin investment plan and you will thank the day you decided to start.
Everything weh you talk here na true talk, e get plenty people weh dis bitcoin don change their lives no be today, people weh start to hold bitcoin when bitcoin first come out, since di time weh bitcoin come out till now, bitcoin never disappoint people weh invest in am, and till now di people still de hold am. That na to tell yu se people still get hope for bitcoin .Na dis thin make we  go make sure se we go get bitcoin for our investment portfolio and no other asset de like am.

Bitcoin na baba, e don make gain scatter, e don make millionaires scatter, no other digital asset weh don make di kind gain weh bitcoin don make. I won tell you se to invest in bitcoin never de late , because na now weh di interest even de high sef. Make we invest and make we de patient, we go reap am plenty tomorrow.