Yes bitcoin holding e dey good for di people wey dey interested. But we have to know dat di market e dey volatile, both from di bitcoin side and from di local exchange rate. Like, dis few days Naira e dey get gain against di dollar which na good thing but e go affect those wey get good number of bitcoin before because when dem go sell am the amount no go dey same when the price been dey high. And if di price go down well well go affect more but for those wey go invest wen di price e dey low, dem go enjoy am.
Invest in bitcoin at the right time and enjoy di benefits.
Who tell you say them go like sell their bitcoin for this cheap price. Wetin OP mean be say, instead of you to dey save for bank due to the flaws for Naira and Nigeria system, make you keep your savings for bitcoin. When I means saving no be the money wey you won use do something next week or next month. Na the money wey you won save for long periods of time. If you use such money buy bitcoin, you go hodli till the price go increase well well.