Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Watin inspired you to join the bitcoin forum?
by
AmaGold70
on 07/09/2025, 20:31:29 UTC
Everybody with there respective reasons of joining the forums, but I know bitcoin forum has make it easier for bitcoin lovers to meet together and share together their different views and ideas about bitcoin related issues,

But i know say all of us get our unique reasons of joining the forum, pls let the conversation flow, thank
The forum stands for anything related to crypto currency and Bitcoin na the oga kpatakpata of them all wey come get value, so the major thing wey carry me come this forum na to learn about Bitcoin and how to invest and everything. I seek for knowledge first before I go into the money part, the second thing wey carry me come this place na also to make money wey I go take dey survive because street no dey smile give us again oo and na this place save me from sapa wey been hold me down so I go talk say the thing wey bring me this forum na to learn about Bitcoin and also to make money through signature campaigns because why not.