Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Seeing the investor's mistakes as learning opportunities to newbies.
by
Hypnotizer
on 08/09/2025, 09:38:08 UTC
You don raise better point about knowledge of younger ones, especially about the economic situation many people are facing today. I go like talk some important thought to consider:
1.Knowing Wetin cryptocurrency be: as we dey see now cryptocurrencies dey become popular this days, so young people suppose know everything about the risks and volatility wey dey inside the investment to avoid mistakes wey elder ones do.
2.Investment mindset: if young people get investment mindset early e go help dem for the future well well. And if pesin get investment mindset e go get confidence to start the investment with the small amount wey him get.
3.Mentorship: having mentors wey go help you through your journey and provide you with more networks dey very important for young pesin wey wan grow.
4. Learning from personal mistakes and mistakes from others: as young pesin wey dey grow you need to dey learn from mistakes wey you make and the mistakes wey other people make to improve in your development journey.