@OP you have said it all but the things wey I go like add to this be say make we dey avoid sharing our wallet address publicly (especially if u no dey use Electrum wallet) because e dey increase the possibility of this dust attacks…and you go still fit consider mixing services or using coin anonymization tools to safeguard your privacy but you gat dey careful when using dem…..and make we dey very cautious about every small or large transaction wey we wan do and make we make sure say we keep track of our unspent UTXOs.
This dust attack dey very complicated and so we need to understand how these attacks dey work and make we implement the protective measures wey we know to avoid losing our privacy.