If he also explained the necessary information needed for me to believe. If the person told me about how the adoption is increasing and the bitcoin limited supply of 21 million BTC, I will believe.
You dey talk all dis wan now on hindsight. On d spot wen Bitcoin neva get dis level of mention and awareness, u nor go believe. Those wey even tried to invest in Bitcoin those days in question na tech savvy dudes dem. Those wey nor dey techy but wanted to risk am just threw like $10–$20 or less into am. And na most of dem loss dem private keys and access to their wallets as we dey talk bc dem nor believe sey Bitcoin go amount to anything in future. They just invested so dat those preaching Bitcoin to dem go let dem rest.
Since I came to this forum, I read about bitcoin very well and I believe to the extent I know it will become global reserve, and which is what that is happening now.
But of course, how dem go born pikin for riverine area im nor go sabi swim na? Virtually everybodi wey dey here believe in Bitcoin. Na dat interest even bi wetin bring all of us together here. In fact, those my early years for dis forum e almost be like taboo for people to talk anything negative about Bitcoin without collecting wotowoto. On a few cases sef, e get people wey dem tag and distrust on d allegation sey dem dey mislead people about Bitcoin 😏. Dat era na war to sey anything wey be like attack on Bitcoin. Nor be now wey forum don dey calm and people fit express a contrary opinion on Bitcoin.