Greetings everyone, as I was reading through my feed on X earlier today I saw a news that Paypal wan integrate bitcoin and crypto into their P2P payment.
Link to news: https://x.com/bitcoinmagazine/status/1967577646512140518?s=46As we all know the main purpose of bitcoin creation nah to serve as currency and with the way things dey go naw, the adoption rate dey increase everyday showing bitcoin will soon become the global currency, this step wey PayPal take go increase the visibility of bitcoin and other cryptocurrencies and the adoption of bitcoin because say PayPal nah giant for the field of finances and for dem to adopt bitcoin as a means of payment, many people go start to dey adopt bitcoin too because dem get almost 430m+ users and e go make bitcoin dey accessible to everybody for everyday usage.
As the adaptation of bitcoin increases, e go influence the price because as fintech dey adopt bitcoin e go get upside long-term benefits which means that this adoption by PayPal go dey beneficial to everybody but the people Holding bitcoin go benefit more. PayPal wan to keep being relevant even in the future nah why dem take this bold step, they have seen how bitcoin dey slowly conquer the world.
The future of bitcoin is very much bright and as this fintechs dey slowly integrate bitcoin into their payment system e dey give us hint about how bright the future go be and dey know it that is why dem dey slowly merge into crypto make dem no leave dem for back.
What are you doing with your bitcoin…?
Hodl Hodl Hodl
So you won’t be left out ……….this is a green light for people doubting Bitcoin long term capabilities.