Dis na matter wey concern our Rivers State politicians and the federal government of awa country wey be Nigeria.
E no sey e get catacata wey bin de happen between our suspended governor wey be Fugbara and di person wey be di former governor of Rivers State, and the present minister of federal capital territory wey be Abuja, di catacata de very serious to di extent wey be sey dia two no fit settle wey come make di president come de involve for di catacata, wey come make am give governor Fugbara suspension for six months wey come make dem put sole administrator wey bi retired admiral Ibok.
Now, wey the suspension don de complete, because i hiaram sey di suspended governor wey be Fugbara go come back to office on di 18/09/2025, my question be say with everything wey don play now, una think sey di governor go still get power to make en own decision? abi na de federal government go de influence en decision?
I need una contribution for dis matta.
This whole matter dey so long and very clear considering the agreements wey Mr President and Governor Sim get. The whole story just tire person because till now me no see reason wey make oga Presido suspend governor because he gets outstanding with him predecessor. Now the government dor spoil for Governor Sim Fubara hand because from the directives wey Mr President give, na Oga Woke wey be Minister of FCT so nai Governor Fubara go dey take directives from and him no go fit come for second tenure again because e dey too clear say oga Wike no go allow am as to him, he boy dor dey grow feathers so him go definitely wan show am who be boss.
The prayer be say make the remaining years wey Governor Fubara go use rule go smoothly for am because to me o, even the Sole Administrator wey just hold power for months go dor set him pass full ground and if care is not taken, the doings fit later stress Gov Fubara.