My brothers and sisters I greet ona o. Something just enter my head today to torchlight on this matter small.
Even as we dey learn more about how to secure our bitcoin make we also try dey learn how to secure our live first. I know say na God dey protect but make we try our own first then live the rest for God. Na person wey dey alive dey hodl bitcoin.
Snake na wetin dey really worry for many of our homes, even some offices too. Make we see some reasons why snake dey enter house:
- Haunt for preys:
Snake no just dey come house, e dey come find food wey him go chop like lizard, rat, frog, etc.
- Condusive Environment:
Snake dey like where dey chilling especially for hot afternoon because of the kind body wey dem get naim make you ft jam snake for your WC at times.
More reasons dey but na d ones I ft remember b this, u go ft add your own for people to learn too.
So how we go ft take reduce or prevent this snakes from our homes? Oya check d following list, feel free to add more to this information:
-The first thing na to keep your house neat at all time, this one go reduce way rats and other rodents dey enter our house. You ft buy otapiapia or kill and dry to control rodents too.
- If you see hole or gap for door, window or any entry point for your house abeg try dey block am so that space no go dey for them to use enter.
- Try dey cut grass comot from your surroundings, some people go dey allow their environment dey like sambisa forest first before them go cut am, my brother na you life you dey endanger o, no use your hand kpai yourself.
- No dey hip firewood for house like that, snakes dey sabi use am as source of shelter and hideout.
If you ft do all these things, snakes no go really dey enjoy to come around your environment like that. I say make I drop this safety tips for here because we need to stay alive to enjoy the bitcoin wey we dey hodl.
If you get more contributions abeg feel free to add your own. Stay safe, one love.