Why you no write all the post with our Pigin intonation since the post na for people like me wey need am. I like the post but I dey fear if I forget my authenticator or I lose my phone, how I go take login? I no like the authenticator of my account because I get to children for house wey fit spoil my phone anytime and that one now fit make me no fit come this forum again.
You write this post for newbies and you be newbie too baba. How you wan take explain this one now. Another thing I wan talk about be say your imagine too big and e full for the screen of my phone. Abeg help me reduce the size so I no go need to dey zoom am everytime I wan read your message. Your post sweet me for body well well.