Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: "For a Nigerian investor: buying a land or buying of Bitcoin?"preference.
by
Finebone
on 21/09/2025, 13:34:01 UTC
⭐ Merited by Juicyhome (2)
My people, abeg make we reason this thing well. For Naija, everybody dey talk say land na real wealth and e no dey lose value, and once you own am, na asset wey fit pass from generation to generation. But now we get Bitcoin, one digital money wey don surprise the world with crazy growth and international respect. So for a normal Nigerian wey dey find how to secure tomorrow, the question be:
>To buy land (plots/real estate) or to buy Bitcoin?

>Which one go hold better value in the next 10–20 years?

Land dey solid but government wahala and paperwork fit stress person. Bitcoin dey borderless but the price dey shake up and down. Which one really guarantee wealth for Nigerians?

Lol, Make we yarn,  if ₦5m dey your hand right now, you go put am inside land or inside Bitcoin? Thoughts.

As a son of the soil in Nigeria, I know say we value land pass Bitcoin presently, even though in the past ten years, Bitcoin was the fastest growing asset, but due to the fact say land don make names for himself already, e go take us years to accept say Bitcoin presently is a better investment than land, and why I say so is that the growth potential of Bitcoin is still very high. I know say some land carry such potential once companies and schools are built closed to it, but a typical Nigerian go choose land over Bitcoin every day.
As for your question, if I hold five million now, I go buy Bitcoin and hold because I know what's up already, but most people go still choose land sha.