My people, abeg make we reason this thing well. For Naija, everybody dey talk say land na real wealth and e no dey lose value, and once you own am, na asset wey fit pass from generation to generation.
Land na asset and e nor dey lose value until I go buy d wan wey dey for flood area unknowingly or d wan wey dey in dispute. Na dat time u go carry hand for head sey u don enta wan chance. D truth be sey anything investment nor dey always go straight as we dey often think am. Risk dey all of dem.
Lol, Make we yarn, if ₦5m dey your hand right now, you go put am inside land or inside Bitcoin? Thoughts.
Dis wan nor be financial advice. But make I talk how I go handle dat situation (it has proved to wok, anyway). If I get dat ₦5m so, na d period wey I get am go decide where I go put am. For instance, if I get an now now I go put an inside Bitcoin. But if I get am like in 2026, I go put am inside land. Now, I go dey rotate am go like dat. During halving year for Bitcoin, I go sell d land carry d cash buy Bitcoin. As soon as we dey enta bear season, I go sell off d Bitcoin and carry am buy land again.