Na the federal government go dey influence him decision, because him no get power over the legislatures, and some policies way him go bring go dey pushed aside if e no dey in the interest of wike and presido. Omo the truth be say, if me be Fubara, I for don resign, there is literally no government arm way him fit preside over, all the appointments has already been made, Omo enh, the guy just dey handicapped. I also feel say, him no get mind to make tough decisions and stand on it. I personally no dey happy to see am come back self, imagine after all the embarrassment.
This one way you talk no be lie my brother, na the plan of Wike and the President be that, they done they find way to control the affairs of Rivers State despite the return of the government wey them suspend, i no go they suprise to see Sim Fubara deviate from em core agenda before them suspend am to something else cause who know the conditions them done give am behind those close door meetings them get.
My hope na say regardless of wetin them wan use am do make them allow am collect all those unfinished projects especially the roads and fly overs wey eh no complete, no be when allocation come them go collect lion share come leave am with little money to handle the affairs of the state.