I agree with the other points wey you raise but I no agree with this your number 1 point. People wey de for developing countries get more access to traditional banking system because e de very easy to open bank account. Almost everybody get bank account but na very few people get crypto wallet and people wey get cryptocurrency prefer to spend dem traditional currencies pass cryptocurrency. Furthermore na how many businesses wey you don see wey de accept cryptocurrency
But I can agree with you say cryptocurrency integration into the financial systems na innovation added to di regular traditional financial systems wey we don de used to. I need to emphasize say cryptocurrency for economic growth na on personal levels, meaning say e only de profitable to who hold am, some de trade dem while others de invest in dem. Cryptocurrency on it's own no go fit to improve any economy. And when we de talk about cryptocurrency na Bitcoin be di one wey be dem oga because na store of value wey de give profit on di long term