Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Must everyone invest in Bitcoin?
by
Mpamaegbu
on 24/09/2025, 09:54:35 UTC
Well my own opinion and reply to him is that it's a matter of choice, Bitcoin investment is not forced on anyone...
Na true u talk but na as many people here dey make am look like sey if persin nor invest in Bitcoin d persin nor dey wise. I know some people for dis space wey dey like talk down on those wey dey invest in altcoins but behind closed doors these ones are also investing heavily in altcoins. D hypocrisy for dis space nor be small. My own be sey anything wey catch ur fancy and fit give u enough ROI, make u do am. For those I coach, I dey remind dem sey na Bitcoin dey less risky compared to other crypto investments but Bitcoin investment nor fit give dem d type of profit wey altcoin investments dey give on short term; sometimes even on long term.