Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Don't discouraged me that am wasting my time investment in bitcoin
by
Mpamaegbu
on 24/09/2025, 11:57:33 UTC
Many people are very good in discouraging others from pursuing their dreams, and  that is very bad...
Make I just address dat part in quote. Sometimes sef, those wey dey discourage u nor dey know sey wetin dem dey do na discouragement. Dem dey think sey dem dey protect u from harm. Na dis be d reason why anybodi wey dey do anything wey dem conviction grab nor supposed listen to anything wey people dey talk wey nor align wit wetin dem convince. Nor let dat happen. I remember d story of Seal, wan Nigeria musician back in d days. OGs dem go sabi d dude. Seal mama go hide Seal passport so dat Seal nor go fit japa, according to d story wey circulate dat time. All dis happened when japa neva even become something sef. I think na early 90s or so e happen. Her reason be sey she nor want make her son leave her. Una know mother's love na. But to d son wey be Seal, na act of wickedness be dat. Na so e dey be. Before we listen to people's advice, we supposed find out who get awa interest at heart.