Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Rivers State Political Crisis.
by
Mpamaegbu
on 24/09/2025, 22:55:17 UTC
E no sey e get catacata wey bin de happen between our suspended governor wey be Fugbara and  di person wey be di former governor of Rivers State, and the present minister of federal capital territory wey be Abuja, di catacata de very serious to di extent wey be sey dia two no fit settle wey come make di president come de involve for di catacata, wey come make am give governor Fugbara suspension for six months wey come make dem put sole administrator wey bi retired admiral Ibok.
Now, wey the suspension don de complete, because i hiaram sey di suspended governor wey be Fugbara go come back to office on di 18/09/2025, my question be say with everything wey don play now, una think sey di governor go still get power to make en own decision? abi na de federal government go de influence en decision?
I need una contribution for dis matta.
Dat Sim Fubara dude just messed himself up by going back there as the emergency rule ended. He has just emasculated himself by dat act. Which mouth wey im go get again as govnor. Nothing at all. No levels. Him go just dey there now as stooge to Wike. It's a pity wetin some people go fit do just to remain relevant in life. He wan continue to dey enjoy convoy ride and d hypocrisy of people wey go dey shout "his excellency" follow am like dog dey follow persin wey get runny stomach.

On Wike's part, it's a pity d godfatherism wey him condemned as govnor na im him com dey do.