My people, abeg make we reason this thing well. For Naija, everybody dey talk say land na real wealth and e no dey lose value, and once you own am, na asset wey fit pass from generation to generation. But now we get Bitcoin, one digital money wey don surprise the world with crazy growth and international respect. So for a normal Nigerian wey dey find how to secure tomorrow, the question be:
>To buy land (plots/real estate) or to buy Bitcoin?
>Which one go hold better value in the next 10–20 years?
Land dey solid but government wahala and paperwork fit stress person. Bitcoin dey borderless but the price dey shake up and down. Which one really guarantee wealth for Nigerians?
Lol, Make we yarn, if ₦5m dey your hand right now, you go put am inside land or inside Bitcoin? Thoughts.
These questions na real matter oo and person need dey careful for the one wey you go choose but the two of them na correct investment wey go benefit you and your generation well well, for me if I get 5m now for hand I go put hand for Bitcoin investment and land investment too, I go share the money take buy small Bitcoin hold come take the remaining buy land. For the area wey I dey now land of 1m dey and you fit sell am 3m or more sef in a few years time. And in the next 10-20 years that land of 1m go don add money wey go surprise you and na so Bitcoin investment dey too. So I go do the two.