Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Why Newbies Fail in Bitcoin Investing. Lessons from 2017 & 2025
by
Hypnotizer
on 27/09/2025, 16:58:49 UTC
@OP you don raise important topic about the the reason why many people dey fail for their investment and you have listed quite enough reasons why dey do fail but Wetin I go like make I elaborate more be

2. Short-term thinking: There are many people who invest a lot of money in a short time because they want to become rich very quickly. I think this is very dangerous. Since 2017, the price of Bitcoin has been very low and high for a short time. But after a long time, the price of Bitcoin has increased unexpectedly. Therefore, all investors should make a decision to invest for a long time.

Many people for our society wan quick rich syndrome and dey think bitcoin investment is one of the rich quick syndrome and as you mentioned many people dey invest for short term and most of dem wey take am as rich quick syndrome and dey invest for short term jus hear about bitcoin for the first time through media and so dem dey see profit wey somebody get for him long term investment as same profit wey dem go also get if dem jus hold for short term which is not so,  mostly dem no too dey do research make dem learn about how to trade in bitcoin and to know which Is best between short term or long term investments. If pesin wey wan venture into bitcoin investment do proper research and learn more about it before him carry him investment money into bitcoin e go save am from unnecessary FUD wey dey make dem settle for short term investment.

If pesin do research before him join bitcoin investment e go understand plenti benefits wey dey long term investment because you can’t even compare the profit that people earn from long term investment in bitcoin to that of short term traders.



Quote

4. Risk Management: Many people invest without understanding the importance of an emergency fund or reserve fund. They buy Bitcoin with all the money they have saved together without forming any kind of emergency fund or reserve fund. This means that if there is any kind of financial problem in the future, then  may have to sell Bitcoin due to lack of a back-up fund.

5. Media hype: Many people have invested in Bitcoin due to influence from various types of social media. Due to this, many have faced losses in the past. You should learn and research the following and invest.


Risk management nah another important thing wey pesin suppose consider before him start bitcoin investment or any type of investment, lack of having liquidity for future emergencies fit cause lot of situations wey go lead to an investor selling off his investments at loss because of an unexpected emergency. So e dey very important to have a good cash flowing investment if you wan Hodl your bitcoin for long term to avoid any situation wey go make you sell your investment at loss most especially for investors wey no get financial stability, having a cash flowing investment, emergency saving funds and side hustle go help you for your long term bitcoin investment journey.

Media hype nah important something wey dey make bitcoin more popular and e dey increase the number of people wey go dey interested in bitcoin investment but mostatimes where the problem dey be say, the people wey the hype meet dem no dey do proper research before they invest and some of dem dey take bitcoin as a rich quick syndrome because of the way they see people hyping it, so they go jus enter the investment without basic knowledge about the investment and nah why mostly FUD dey catch dem especially during bearish period. People wey know about bitcoin through media go need to get a very reliable source for  news regarding bitcoin to save their selves FUD because if you just dey consume any news from any source about bitcoin e go cause plenti FUD for you and sometimes news from other sources fit be fake news and some fake news fit lead investors to losses.