Search content
Sort by

Showing 4 of 4 results by Mansoveh
Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Topic OP
Where This Generation Dey Head Go
by
Mansoveh
on 10/07/2025, 10:08:19 UTC
Omo, where this country dey go like this? E be like say Nigeria don dey head one kind direction wey no clear. This our young generation no get patience at all again. Na just yesterday internet begin scatter with news say one SS1 student buy Mercedes Benz and I decided say make i share to this place. Him papa tell am make e return the car, but guess wetin happen? Him own friends dey advise am make e no listen to him papa. Imagine that kain thing!

Na from there person go know say bad friends fit destroy person life. Instead make dem support the papa, dem dey encourage the boy to go against him own father.

Make we reason am weller where SS1 boy wan see money take buy Benz if no be Yahoo or some kind illegal move? Small pikin wey never even finish secondary school don dey do pass him level. Now small children don dey ask for “update” up and down and we all sabi wetin that “update” mean.

The matter really weak me. Things don spoil reach this level. We gats be very careful with the kind people we dey call our friends. If we no watch who we move with, we go just use our hand enter serious gbege wey fit destroy our future.

Make una watch the video too https://x.com/yabaleftonline/status/1942486896522792968?s=46
Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Topic OP
Nigeria Don Finally Recognize Bitcoin as Legal Investment
by
Mansoveh
on 09/07/2025, 11:56:52 UTC
This one na big move wey Nigeria government take recently through one new law wey dem call:
  • Investment and Securities Act (USA) 2025

    The Law go change plenty things for crypto space, especially how Bitcoin and other crypto assets dey treated.

    1. Bitcoin & Crypto Now Get Legal Backing

    Before:
    • CBN say banks no fit allow crypto transactions (2021 ban)
    • Crypto no be legal or illegal, e just dey for grey area

    Now:
    • Bitcoin don officially become "a regulated investment" under Nigeria law
    • Na Securities and Exchange Commission SEC go now regulate am
    So Bitcoin don move from "underground hustle" to "official investment asset"

    2. Exchanges Must now Register with SEC

    Any crypto exchange (like Binance, Luno, Kucoin wey wan operate for Nigeria now must register and get license from SEC as

    That means:
    • Dem go do KYC (Know Your Customer)
    • Dem go follow anti-money laundering (AML) laws
    • Dem go pay tax like normal financial institutions

    No be play again. If you no get license, SEC fit come after you.

    3. Crypto Transactions Now Fit Be Traced and Taxed

    As crypto don enter official investment zone:

    • Government go now dey monitor transactions more
    • You fit need to pay capital gains for tax if your Bitcoin grow in value
    • They go dey ask where the crypto come from and who send am, etc.

    If you dey cash out ₦5M worth of Bitcoin, dem go want know the origin

    4. Investors Now Get Legal Protection (But na Two Edged Sword)

    Now wey Crypto don legal:

    • If exchange run you scam or run with your money, you fit go court legally under SEC rule.
    • But at the same time, if you run fraud using Bitcoin, dem fit now arrest you faster because everything don enter legal system.

      BUT: The problem still never finish
      Even with all this:
    • Banks still dey freeze people account wey dem suspect of crypto
    • SEC never really approve many exchanges to operate freely
    • Law dey ground but the implementation still dey slow


    So for now, na still half leg in, half leg out.
    If everything dey normal now, It will be a big win for crypto future in Nigeria, even though road still rough small because.

    • You as investor get more protection, but government go still dey monitor your movement
    • E go reduce scam for space, but you must do things in legit way

    Source: https://nairametrics.com/2025/04/04/isa-2025-nigeria-formally-recognizes-cryptocurrency-as-securities-in-new-sec-act-2025/
Post
Topic
Board Beginners & Help
Topic OP
Newbie Here, Ready to Learn, Contribute and Take Advice
by
Mansoveh
on 08/07/2025, 22:57:33 UTC
Hello everyone

I joined this wonderful place over a year ago, but I couldn’t stay active due to other activities. Now that I have more time, I am completely ready to give the fullest effort, learn as much as I can, and contribute to the community. Even if I'm still a newbie when it comes to Bitcoin and cryptocurrency, I'm ready to follow the forum rules and improve with the support of the amazing community. I'm also open and willing to hear any advice or help from more experienced members every bit of advice counts in this journey. I'm glad to be here and happy about the journey ahead. Thank you.
Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: A friend scammed me of my PI
by
Mansoveh
on 25/02/2025, 13:18:30 UTC
How many years now dat people have been mining Pi? If I can get it right Omo over 7 years and they still have the patient to wait for the listing day. Even if you no start the mining early, u sef try because e no easy to minet over 100 pi. Sorry for that, you should have exercise more patients because na d main koko wey crypto area require be dat.