Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: African bitcointalk community hangout
by
nelson4lov
on 17/07/2020, 19:41:06 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
~
@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small

Omo Brainboss, Your man just dey like dele. Remember say I dey learn web development na? I participate for one internship like that – HNG internship. The stress been dey too much so tey I stop after sickness kick in. But I reach the point to get IT placement wey I fit use next year.

That aside, you see this matter una dey yarn so? About falling/participating in scam? mehn me sef get story to tell Oo. The road no dey ever dey straightforward. I remember some hyip I join then, 3.14%  daily. Most of my friends then chop, but immediately I put my cash wey I earn from faucets then, them go maintenance till today, maintenence never finish. No be only that one sha but I want keep my story short. Since then I vow never to enter a ponzi/hyip or any scheme wey dey too good to be true. Na why this new stuffs like Ethereum Money and forsage, I dey frown when people talk about them coz all na to rub peter to pay paul.