Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: African bitcointalk community hangout
by
gabbie2010
on 17/07/2020, 21:32:46 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.

@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.

@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
I jam this thread and come explore am I dey gbadun una tory here well well na im I come pack here jejely make I make I dey learn how una dey buy all those coins wey una dey talk about, I no say you people na oga here in this forum CryptopreneurBrainboss and mpamaegbu una gramama na baba me wey bi say na science student I be learner.
Nigerians no dey dull themselves in these obodo oyinbo forum me self I don learn many things here and I don learn how to run commot for any Hyips and ponzi schemes MMM don teach many mumu lessons wey be unforgettable I no dey go near thing like that again.
I beg make una keep this thread going so that we no go carry last here.