Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
Becky666
on 18/07/2020, 08:38:46 UTC
Na wah oh e get persin wey never fall mumu to dose scams before? Take God self for some of them because if no be MMM I no sure una for don see me for dis forum. Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open. All na experience and we don grab am major.
Boss, im get as e b dat time wen MMM com to naija, almost all my Peep's fell yakata 4 dis but me escape dat plague. But, weti go mak person fall first time nd still fall again nd again if no b greediness? My big broda wey dey here fell some few days ago for dose Facebook investment packages again.
Quote
@Becky666 my eye still dey for that coin but small development been sure up so I get to sell sharp sharp to buy back my DGTX (thank God e don rise). I still go buy some of the ARPACHAIN before month end. This two coins na my major bags.
DGTX shud b my next target. im go gud we dey talk for dis house about possible coins wey go giv profit make we dey take profit small small.
Quote
@Nelson4lov where you lost go, well thank God we don dey come back small small
Maybe na real-world hustling tins, happy to see u back broda.