Back in the early days I mumu die, na hyip, doublers, Ponzi abi matrix or wetin dem dey call am self, I no do? I do all but thank God today persin eye don open.
The matter don tey, Ponzi don run men down. Especially our innocent Nigerian youths wey de hustle for internet, them don fall for scam tey tey and still de fall. My self gon gather story for ponzi scheme, them don run me tire. So tey I package my self come go buy touchlight phone make I for no the surf internet again, but for where e no work out. After 3weeks I still jack another phone again, that time bitcoin come begin ring for my head, as I enter na so I take sabi about Cryptocurrency and I no gree leave am again.
The funniest thing be say I never earn 1 kobo from crypto, since I start early 2019 but e get as e better pass those Ponzi wey I lost my money no still earn shishi.
The Koko be say, I happy as I don fashi those hyip and ponzi and i believe say everywhere go stew as we never give up the hustle.
@CyptopreneurBrainboss e get as you be motivation for me, na the best the always come from you.