Mehn today just dey pain me like this. See SYScoin wey I suppose enter go pump 3x in 24 hours without me on the train. Their team yarn say big news dey come by 23rd July. If the news no leave up to people expectations, e go just dump massively. I no wan enter now coz e fit come get corrections.
You don check Cartesi wey I mention earlier. E dey Binance o.
Yes, That cartesi eh, I don dey hear as people dey talk about am of recent. E be like something go sup with am soon. But since them still dey distribute bounties, I go chill first, see if I fit get am a little cheaper.
E get another new one wey I dey shook eye put. Na Platincoin. E dey CMC already and I go like make una help me police am too.
Okay. I go check tge coin out though I never hear of am before. I dey mostly trade coins wey dey binance.