For those of una wey buy Cartesi, make una nor panic as e bi now sey e don drop shikini Satoshi. Na the effect of the last bounty distribution cause am wey dem distribute on July 23. Look for any angle to buy more. Na better coin be that.
Na how the matter the take play be that. As e fall like this many people go run go sell the small them get make all for no lost. Last last na who get that business oriented mind; patient and believe go laugh last, I see future for that coin too, e go raise as I de take eye see am so...
Na true. Like me now I bin sell that yesterday but I don rebuy am today with extra tokens to show for it. If you see any opening sey any utility coin wey you dey hold wan fall, na to sharperly sell am and then wait for the weak hands to follow dump. Una sabi sey some people go just begin running for streets once dem see other people dey run without knowing wetin dey pursue dem, ba? 😂😂
Then as a guyman wey you be, just smile and then quickly buy am back to add more to your hodlings. Na so the parole dey be oh but you gat to be very careful sha. Otherwise, you fit sell and not be able to buy back and then the cruise go leave you behind.