* I got pregnant when I was in SS3 and was banned from singing in church choir: -Aituaje Iruobe (Waje)
Ehen na, before nko wetin dem suppose do for you for being wayward? Dem for fry egg, bake cake and clap for you on top the belle wey you carry, abi? Iranu oshi.
Jack Mai (the persin wey get Alibaba) own story too make sense but e bi like sey you forget to add am. Even Abraham Lincoln own too. All those owa polithieftians stories nor dey touch me shimkpan. Nothing nothing for them.
I greet everyone for the house. I been wan come officially tell the house say local man been don finally reach hero rank and e for no dey possible without una support so I thank una. The reason I never dey active here much be say, I been dey seriously sick.
Congratulobia Nelson for the new rank. Welludone. E remain me. But my own journey be like sey na crawl I dey crawl oh. Ehen, make I thank God for your recovery. Kpele, abeg nor sick oh, or sick but make you always recover 🤡🤡. God punish devil...