Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
Becky666
on 16/09/2020, 20:41:49 UTC

This na secret wey I been dey find since, as the market dey red everywhere, na the best option be this I swear down, among these coins you list down, me I prefer ATOM not because of the high ROI percentage but because of the project itself, I watched ATOM at $1.5 price but now na around $5.6, also them get tiny withdrawal fee and high volume and volatility, I never stake before so I go use trust wallet as you talk make I partake.
I like ur muscles bros, dis one na sense u giv oooo. Me dey follow KAVA shaoo becus of deir project and network in cryptospace, I will add dis ATOM now tank u.


among these coins you list down, me I prefer ATOM not because of the high ROI percentage but because of the project itself, I watched ATOM at $1.5 price but now na around $5.6
I hope sey you manage to pack small when e dey cheap abi you escort the price go up because of fear fear 😂. Trading na the easiest way to increase any unit of coin wet you get. But you must know the game wella to do am well. Otherwise, na sorry by the end.
My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam Cheesy I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals Cheesy