Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
BIN-BIN
on 27/11/2020, 08:42:03 UTC
My broda, many tins dey happen for dis market, hope sey no b me d negative ones dey happen only? Trade eh, na scam Cheesy I see am, especially wen u no get otumopor. E b like sey theory na em  people dey use pass practical for trading: e shock u abi? Me self I sabi theory well-well but dey fuckup during practicals Cheesy I don lose some dollars now.
Chaiii! E just be like say you dey my mind. The trading eh, e be like say na you(we) them dey wait for. Like say one man just dey wan side dey move the wave and as e dey move am, e dey watch you. Once you say make you place trade, na once you go begin see consolidation or the trend go just go against you.
E con be like say, the theory way person know don dey out dated. The matter tire me just now.
I been venture into trading in the last couple of months back, baba na the same thing I see ooo. Once you place your sell other and it bought up boom the market go just speed up but when you come buy na then the market go just drop. I lost almost all my profits and even capital join self but I borrow my self brain I come jarpa.