Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
Mpamaegbu
on 23/12/2020, 19:19:02 UTC
⭐ Merited by igehhh (1)
Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).

Omo my guys, I dey new here,I dey post nice tinz but I no dey get merits.
Then secondly them never update my activity to ryhme with my post.
I need help jare!!
Welcome bro. Sorry sey I skipped your post the other time as I dey hurry out when I put that comment on congratulobia to Brainboss.

I salute una oo my pitakwa brodas how we go tak sidon enjoy oursef even na d least fowl feather we chop and to tell baba God thank u 4 dis Xmas? Oga brainboss baba God dey shame ur village pipo small small 4 here congratulobia broda ur face show. Grin

Anybody wey get awoof mak u try dash ur broda una grab wetin I mean na. Una too dey belleful oyibo ooo
Pitakwa people, e bi like sey na una go rock this December. Suya or chicken barbeque nor go dey bad to handle with all the big boys here. Make una sha remember to share pictures later with us oh. Persin wey nor chop can still watch pishures na 😁. I know very soon most of the polithieftians for PH go begin enrol for this forum to equip themselves with Bitcoin knowledge.

About the awoof wey you talk, I understand you. Just continue with your work, e go come when you least expect am.