Hope sey na im "pearls" still giv am dis award ni?, bad peps evarywher. I don come 2 undastad sey him wey God bless no body wey go fit cause am, nor itimidate am, my sincere greeting sir, we all tap into dis ur success dat b4 2020 end we go all colet our own blessings accordingly, once again a big Congratulations Boss, more go cum(**) 2021.
<snip> Make I take this opportunity beg all man here sey make dem dey very careful with anything dem dey do here as many of those peeps eyes dey for owa parole now. E go give dem excess joy to see sey dem tarnish owa imagine with red as I dey see dem. Make una shine eyes like pussycat oh and reason the matta wella wey I just throwey for ground now.
One love my people! Feliz navidad...(Felix Na dibia 🤣)
I belive sey dat plenty pee peopu don read dis ur advise, de tin go giv dem joy if dey succeed but God gat our back 4 sure. We neva 4get dat one wey happen to out broda posi, so, make we dey very careful bikonu.
Happy Christmas 🎄my pipo abeg if u get two plates of rice abeg dash ur neighbour one plate because e get as thins be dis year for some pipo. We get plenty challenge for dis country but no reason we go settle dat one next year.
Dat one na 4 sure becus dia's love in sharing, tank u.
As 4 me I no celebrate dis year as my Mama kpai 4weeks ago our house no get joy. Una wey get reason to celebrate make una enjoy.
Our oga dem make una do xmas awoof na

We all get reason to be joyful becus our eyes don see anoda 25th again, but am sorry 4 ur mama matter, please tak heart ehh, na so life be, may our God keep mama till we meet again.