Username: Nelkel007
Gender: Male
State: Rivers State
Skills: newbie ( I dey here to learn).
Dis guy don comot from dis place as police 4 here report am say him do plagiarism, d thin just vex me plenty when him don gada small merits. Even wen you draw deir ear say dat kind tin no follow for here, dem no wan hear sometin.
My dear, you dey mind dem. Pepper body too much for those guys side. Dem nor wan make anything Africa shine. E even worse once dem know sey na Naija.
Haha, ur pidgin dey sweet me 4 belle aswear, you tight.
D tin just taya me for all this oyibo pipo, dem no wan make persin follow dem enjoy, all our yan and mata just dey 4 deir room dey mormor con dey yab us like say we no be human being, anywhere e pain dem, make dem scratch am, bad belle pipo. Abeg my men dem, make una no 4kup as dem dey find small mistake wey we go do. Shine ur eye and dey on clear road.
Mona fagi dis Xmas.