Omo. Plagiarism bad Oo and them dey take am very seriously in the forum. Na why I no fit advise anybody to go down that path. Sorry to Nelkel sha. Na my fellow PH guy.
(...)
As 4 me I no celebrate dis year as my Mama kpai 4weeks ago our house no get joy. Una wey get reason to celebrate make una enjoy.
Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Compliment of the season my people. I dey wish everybody happy holiday celebrations with family and friends.
Abeg no forget to enjoy life. When we die, we go leave this world behind so make we just live and enjoy life wey we go remember.