Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Baba life be like wheelbarrow eno balance mama sacrifice for me well well pure water she never drink all d cars I wan buy no way baba I no get joy as I dey so but baba God dey our mata any how ebe
No reason am 2much if not e go wey you. Life no easy that I know and sometimes say person no dey tell e story no mean say e own life better. We all dey passthrough life but d prayer be say baba God go see us through. The feeling you dey get now I understand am. E no easy say your mama go surfer finish and just go like that. Tins like dis go dey make you question God.
But no allow the tin put you down. I remember when I small I tell myself if my mama no chop my money nobody go chop am but as I grow older I come dey small pikin talk inside am. The reason we dey alive na to help people, the moment we don help finish we go go visit our marker.
Hope say una Xmas dey go well. Merry Xmas and happy new year to all man for here for advancementation. Una tight no be beans. Make una no forget oh our 2021 goal na to get local board anything wey you fit contribute like idea to make an a success bring am come.