Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: #EndSARs}
by
nelson4lov
on 30/12/2020, 11:47:17 UTC
Sorry for your loss bro. Na one of the reasons wey make life no fit sweet because at the end of the day, we go still enter ground. Me sef don lose some people but the pain dey get better with time.
Baba life be like wheelbarrow eno balance mama sacrifice for me well well pure water she never drink all d cars I wan buy no way baba I no get joy as I dey so but baba God dey our mata any how ebe

No worry too much. These things happen and God know why. Physical death certain for everybody. Wetin remain for you now na for you to live the life wey she been want you to live and dey happy as you live am. Just like wetin Brainboss talk, everybody get their own stories and struggles. Just no lose focus yet coz everything go fall into place real soon. My friend go always talk say:

Quote
Who dey alive na go enjoy

Big things dey in front of us next year. Stay focused  Smiley