Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: NIN & Local board}
by
Traderbtcc
on 20/02/2021, 11:59:06 UTC
Brodaly as you see me so the country don tire me, people no fit speak against the government again, because the next thing government go do na to arrest them
because we no fit talk and yet, we dey act like say we dey free. Na only government and there interest the armed forces dey protect shah.
Like this no be democratic country naija be again as the government Don decide to forcefully control the citizens, we no fit impeach am because him dey like untouchable there, this APC Party I been always know say them dey up to no good, the people no care about the citizens na only their belle matter, wetin or how the citizens feel no concern them.
quote author=Theoboy link=topic=5121680.msg56389871#msg56389871 date=1613756616]
And of recent dem shun the part of insecurity for the country especially for North side go enter NO BLEACHING CREAM🤣. I mean which country the do this kind thing🤣. Them shun insecurity go the fight against bleaching
Abeg make we do make d country wake up Small
My sister(s) my brothers e go end soon make we jst get hope😁
[/quote]
Omo this naija na cruise if you take am serious u fit go die for nothing, we dey live for failed  state, the people for power no care about the citizens.
Naija don tire people, we see how cost goods dey rise, although not surprising say e dey rise, but the rate it dey rise come worse. Naija economy enter recession again last year, we no dey recession again this year though but the inflation rate dey increase while unemployment na issue.
😀Since them say na my father's land, omo I Wan kukuma sell the thing carry my money go, anybody way born for Nigeria already life Don dey win u 1-0, the cost of living own dey weak me, the worst part as them dey rise e no dey come down again, no work sef, school Don turn scam, NOTHING DEY WORK FOR THE COUNTRY.