Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigerian Bitcointalk Community Hangout. {Current topic: Mining}
by
Josefjix
on 13/03/2021, 12:29:22 UTC
Lol. Nobody fit advice this government to encourage anything that would aid the wellbeing of her citizens, just take a look at the regulation placed on crypto exchanges and banks. Omo, if person set mining equipments/firm for 9ja government go off him light I swear make we no use keyboards dey deceive ourselves. Mining no go work for 9ja.

No be lie oh, I no believe mining go fit work self, the challenges much. First you go need government approval so you fit get constant light on a low budget because if you wan run am yourself e go be for your head, dem go use bill kill you. You know say even the oyibo miners self dem no dey too profit like that immediately unless bitcoin just provoke run dey go up and e be say dem been dey hold the previous coins dem mine.

Make we just leave the mining matter as na dead end. If the OG's wey dey the game for nigeria never reason am, e must get why maybe dem don waka for am see say no way that side oh. If you noticed all of dem go trading and promotion like ambassador can of thing for projects wey relate to the industry. If you think say mining fit work for nigeria, air you own opinion, convince us wella.
I thank God say you sef dey reason the same way with me; if e truly go work, I believe many Nigerians go done dey do am. See other sectors sef wey no need power supply and much government approvals sef still dey suffer to blossom, talk more of mining wey involve plenty electricity consumptions.
Setting the firm up as a sole proprietorship go still hard you. Reasons plenty for ground, people for your backyard fit dey do amebo give government. Government too no come dey friendly with the crypto industry. The only thing wey go work properly na to find small money enter countries within Africa wey no too dey harsh to crypto with their policies and then get better electricity supply and crime rate low for there.


Person no need dey Nigeria to survive by all means, you fit dey anywhere dey make your money and our people talk say Anywhere you find peace, try make am your home
Na my own two cent be this, in case anybody dey plan set up the firm reason all these points wey just join together first.

Baba, you see as BTC dey fly dey go Baba dey para gan.