Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board {Official language, Pidgin}
by
Mpamaegbu
on 07/06/2021, 06:38:28 UTC
As of yesterday our minister of information wey be Lai Muhammad come talk say Twitter NG go stop operation for wey country for disgracing our incompetent presido, and e no end here ooo the shamless people still come twitter to tweet about the ban for the same app  Grin. Our country na yeye.
You dey mind Linus Mohammed? The surprising thing be sey most of these yeye people wey dey yarn dust be highly educated people oh. But their belle because of wetin dem wan eat nor dey allow dem brains work well. Shebi Linus na lawyer sef. Dem forget sey even Jack delete Donald Trump tweet and nothing happen. Jack wey dey US still get mind delete Trump message and nothing happen to am, no FBI worry am. If na naija the guy dey those fish brains for don worry am tey tey.

Even the Twitter ban sef nor be like sey dem even block am well sef. My own still dey show oh small small and I neva begin use VPN sef. Nothing wey these people sabi do well sef.

Ehen, about TB Joshua sef. Una see sey death nor get respect for anybody na. Death nor send anybody oh. Once the time reach, e dey show sharp sharp.