Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria Local Board {Official language, Pidgin}
by
Fivestar4everMVP
on 11/06/2021, 14:37:01 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
Even the Twitter ban sef nor be like sey dem even block am well sef. My own still dey show oh small small and I neva begin use VPN sef. Nothing wey these people sabi do well sef.
My own no dey show again when the network company block ham. Yours still dey work?

Although, the issue wey I get be say notification no dey come, anytime I wan access Twitter I dey use VPN which is very perfect. Hope this no go be a big blow on those bounty hunters, but I hope most of them go don dey use VPN too.
e be like say the stuff dey different for different people Abi na different phone or network, my own Twitter no dey go again but I dey receive notifications from the people wey I dey follow and get notification on for their tweet, but the thing be say when I click on the notification, e no go gree open until I start my VPN connection. One thing wey I dey very sure of be say, no matter wetin this government do, last last, all of us go dey alright.

As for una wey dey wait until una make all the money in the world before una marry, all I get to say na good luck to una, I was once like you people but I thank God say he open my eyes on time to know say no be money be marriage, am 28 years old and I already have a very beautiful wife, I have an angel who calls me daddy, nothing gives me more joy than this, not even the little money I've made