Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board {Official language, Pidgin}
by
Mpamaegbu
on 11/06/2021, 18:19:12 UTC
My own no dey show again when the network company block ham. Yours still dey work?
The thing nor dey update well again. I don switch ova to Vice President of Nigeria and na Orbot I dey use. No hassles with am.


As for una wey dey wait until una make all the money in the world before una marry, all I get to say na good luck to una, I was once like you people but I thank God say he open my eyes on time to know say no be money be marriage, am 28 years old and I already have a very beautiful wife, I have an angel who calls me daddy, nothing gives me more joy than this, not even the little money I've made
According to Oyibo people — This advice takes the trophy!

My broda, the koko be sey who nor go nor go know. D bitter truth be sey wen you dey do boyfriend and girlfriend you go think dey wives plenty. Na lie! Na when you want settle down you go sabi sey women plenty true true but wife scarce. I advise anyone wey dey here wey get any lady wey im wan marry to settle down at once. Money is neva enough. Even, the money sef nor go come as you dey expect am and age go dey waka go small small.