As for una wey dey wait until una make all the money in the world before una marry, all I get to say na good luck to una, I was once like you people but I thank God say he open my eyes on time to know say no be money be marriage, am 28 years old and I already have a very beautiful wife, I have an angel who calls me daddy, nothing gives me more joy than this, not even the little money I've made
No be lie sha but we all get different plan for life, the life I wan my family to live I never fit afford am so e better make I no go bring person come this life when I Know say na suffer dem dey come suffer. see eh some of us for here go through hell as we dey grow up, I no go fit restand my children no see for chop just because I dey hope for better days.
E better I hustle for that better day now and train dem on how to achieve it earlier than me when I settled down. Sha make we leave d mata for another day as we get other stuffs to discuss.
How far una, how the June 12 protests dey go for una side, I hope all of una dey safe. Mehn nigerian don finish like dis. We just dey survive on cruise.