~Snipped
~Snipped
Onto another mata, how una dey see the market, wetin una dey predict. Bitcoin don try many times to break out but e no dey sure for am. Una tink say we dey enta bear or make we just give btc small time more.
For my own opinion, I still maintain my earlier argument say bitcoin never reach the top yet regardless of the current market conditions wey make all crypto coins and tokens to dey on red mode. But I go like acknowledge the fact say the correction don dey last longer than I been expect. I been dey expect say bitcoin suppose don recover go $50000+ zones but every time e try to break those resistance, e go just break down back to $31K to $40k range. So wetin be my conclusion now?
Make we give BTC more time and everything go stew before the end of the year.