I throw salute give you, e good say you get this kind good skills maybe if you build your account well you fit dey do managerial work for here, na only for altcoin discussion I dey see you, I know say you be omoh naija since but I been dey wait make you come around thank God you did you try make men and you cap for telegram e get wet in we go chok mouth for.
Like this eh, I don run go apply the next round way you post o, I go encourage other Nigerians way dey here to go do the same. Make we for dey collect dey go. You do well bro.
I applied last round but I no see result of the winning numbers at all make them dey try dey make the process transparent any which way I go still apply again try luck.
thank you man, i sight you from far too.. like this now i done follow the telegram group but e be like say the group no too dey active for people to dey reply. person been dey ask about community manager so i won sabi the type of community manager wey him they find for the group, if na to do moderator and the rest then make him cap me well for our group there make we see e go be.