If we sabi whatsup na to ignore de rubbish wey CBN dey wan launch dey call am digital currency.
Anybodi weu dey believe CBN for dis kain matta dey try, i dey tell you! Me nor fit try am. Even when my mind sey make im agree small na serious warning my brain dey give mind oh. Hia! How anyone go believe an institution wey wan rubbish owa hustle. Nor be dem ban crypto so dem go fit cripple us financially? When dat one nor work, na so dem ban Twitter to frustrate owa social life. This present CBN under Godwin Emefiele and Naija under Bubu nor be am at all at all.