We nor even get anything against Bitcoin for Nigeria apart from sey our leaders dem nor understand how e dey work and Buhari dey ban am
CBN governor is the one that ban cryptocurrencies in Nigeria, not the president.
Yes na wetin Charles talk legit,
The CBN do not need the president approval or suggestion to ban anything that has to do with monetary value or assets, the CBN get the full power to make the call and to ban whatever they feel will threaten the bank or the government and since bitcoin is against the traditional banking and the government e make dem easy to kick it out.
Una dey talk dis thing like sey una dey for sane societies of Europe and America where institutions dey function without presidential interference. Haaba! Abi una dey wind me no like sey una nor sabi sey all government functionaries dey do wetin Bubu want ba. Who be Emefiele sef to argue wetin dem tell am to do. But wait oh, so una think sey if dem leave Emefiele and give am free hand im go dey do all this rubbish wey im CBN dey do? No nah! The man dey learned to understand how d economy works but na im master tune im dey wan dance to. For instance, make una see the way wey other CBN governors before im take work and the presidents of their time and how dem dey determined to help the economy. Na just simple case I give here. Emefiele own dey different because d present administration nor even send whether d economy dive of not. Shey una listen to VP Osinbajo comment when CBN banned crypto for Naija ba? So, una think sey if na Osinbajo be presido Emefiele go ban Bitcoin? 🤷