Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
CryptopreneurBrainboss
on 27/08/2021, 08:27:24 UTC
Nor be lie, na crypto dey reign for our country because the youths don see say the government nor get them for mind at all. White collar jobs nor dey for common cos oga at the top don keep slot for him children way still dy secondary school. Internet money nai be wetin the youths don see say go fit help them escape sapa.

Aboi no be lienus oh, it no be internet ehh we for don cast since na. I mean imagine how much you fit make by just running one or two things for online wey no involved fraud oh. If you keep your head for ground, you go see say blood money dey for Internet and any body wey first enter they succeed madly. Check our Instagram skits makers na see as those boys and gals they ball. Even when blogging be come out  see people wey first run am dey enjoy now like mad.

This is one of the reasons we need local board, most likely at all, we will discuss more about cryptocurrencies which would be helpful to some Nigerians that access this forum.

No be lie if na dat one me self I no dey border reaaon dem wetin dey sup again because on how you teach then finish and you no follow up  den they come misplaced this private key or lost their phone and no get how to access their wallet again, na u den go dey worry. Now anybody wey dey reason me wallet, I dey just trust wallet atleast that one dey somehow ok then the others but not totally decentralized why if you ask, anything wey binance put hand, fear dem.

That one na very strong point to use pushu this local board mata, we dey very uninformed for Nigeria. When I dey see this shitcoin rubbish e dey worry me. Na we even carry am for head pass  you go dey see careless WhatsApp update them and you know non of dem get any idea of wetin dem dey talk.