Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
Mpamaegbu
on 29/08/2021, 10:02:35 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
E shock you? No reason am oh as dis county don finish.
My broda, nor be small thing oh. Dis day I nor dey even like listen to Nigeria news on radio because d thing dey depress me anytime wey I do. Na one looting or killing or the oda na im persin dey always hear with no solution in sight. Owa leaders dem all be d same, no way forward for d country. But when d fia wey dem dey try set up go catch, e go burn everyone of dem, walahi. Shebi military don declare dat Colonel wey expose how Biko Haram take dey operate and sey na top people dem dey behind am to the public. Instead of Bubu and im people to sit up, na to declare d man wey talk true wanted. Shey na so cowtry wey wan progress dey behave?

Well unless you no smart, I no understand why you go still dey keep funds for bank abi una no see wetin happen for Afghanistan.
No matta how wey we nor like banks because of Bitcoin, we still need to realise sey without banks (fiat) we nor go fit survive with Bitcoin. In fact, to make Bitcoin relevant na im make dem dey fit pair am with $$$. Bitcoin nor fit stand on its own sef without fiat. So, we need bank very much. At least for Africa, we need am wella. Even you Brainboss, if I wan run parole with you now, shebi na through bank we go still do am 🤷