So, even owa late comrade, Beckky666, still make the list as active poster months after im die go. E really show sey Beckky gave his best here d little time wey im dey with us. Na big challenge be dis for those of us wey still dey alive but dey shy away from owa own corner. Abeg, make we sit up and begin come back home like prodigal children. Nothing sweet pass home. Igehhh, you deserve betta wata for this thread and I nor get colele wata from fridge now. I must pour you enough wata once d thing show my side. Weldone, doh!
Ah my brother shame catch me well well when I see the charts o I nor even show face at all. I don see say ah nor dey try at all for our local board matter. Thanks to Igehhh for opening our eye I know many of us nor even de aware say we nor dey try. That chart na wake up call to everyone of us make we step up. I don make up my mind to visit this thread first before I post anything anywhere else for the forum.