
Una see as the matta be there too. Those na local boards of three different countries – 1. France, 2. India and 3. Italy. The green lines show how many sub-boards dem get each. Some many pass the orda. But all of dem get something wey dey keep dem going. I nor even know how happy I go feel anyday wey I wake up come here to find out sey wey don join dat league. What a day it would be! Make I speak small grammar.
For the local board matter, I suggest say make we set the official language as pigin..not pigin English but pigin. Why I talk so? Other local board dey promote their native language them nor dey put body for English matter and nai make other users nor fit dey shook eye for their board. If we make our official language English anybody go fit stroll enter come dey impersonate Nigerian. English nor be our language if we be english people theymos nor go give us local board e go reason say we nor need am. Abeg make we reason this matter?